The New Sheriff in Town Has Done It Again. Una Buy Market When Una Nor Fit Sell

One state wey I know, dem buy market… dem no fit sell am. The first thing na to read budget. Budget wey you suppose don memorize well well. Practice am for house before you come read am.

You reach there:
“Six billion… sixty… six hundred and fif… six hundred and five billion… let me take it again. Sorry, it’s confusing me.” Primary 3 pikin for Okere go read am clean.
Primary 2 pikin for Ngwa Road Primary School go read am neat. 

Your oga, that time wey him be governor, one woman no fit read something — na so him disgrace am publicly. Now you, dem don bring you come.

I remember during campaign, you say you go bring insecurity…
We think say na mistake. But now? When this man dey talk, e be like person wey wan toast babe but fear catch am. E dey nervous. E dey apprehensive. E nearly dey choke.

“Our father president, our father…”
E remain small make e turn am to:
“Our Father who art in heaven, hallowed be thy name… On your mandate we stand?” I never knew Nigeria would degenerate to this level. “Eh… G G S… FFF…”
E remain small make e call am JSS, DTF, or DSS.

God! How did we degenerate to this level? This is a state that produced Aisha Yesufu, VDM, Oba Ovonramwen, Imoudu, Peter Esele, Adams Oshiomhole, Victor Efosa Uwaifo — all kinds of intelligent people.

Na una elect this one? Abi no be una elect am? I suspect say e no even be from that state. Make dem run DNA of the state sef. Maybe na from one nearby state wey dem cross river come. Somebody will ask, why will an old man like me be laughing.
Una go think say we be fools?
You just go carry anything come drop for our head.

Una sabi shoot at Peter Obi.
Una sabi shoot at Professor Osunbor.

A state that produced Ambrose Alli.
Oh God… I remember when Ambrose Alli came to UCH. I spoke with him one-on-one at the medical hostel.

Now, na this one una bring? Una fall hand.
Una no dey carry last before — but now, una carry last.

Any person wey call your name, na him sabi.
No be for my mouth una go hear say “King mess.”

Na so person go get 2 billion votes? Donald Trump called us a “disgraced nation”?
We don pass disgraced nation — we be ungraced nation.

This thing pain me well well.

What is this?!

Shame dey shame me for some people. 

Leave a Reply